Country people, I know say una don tire to dey read all the long long articles wey our ajebutter people dey write. Dis one na tear rubber article wey go de talk about relationships. I like dis our pidgin well well as im no get time for long story. Na summarize full am oh!
…Make our body relate!
…Make my body, make your body relate oh!
No be me sing de song wey dey on top this line wey I dey type so.
Na one bobo wey im Papa and Mama born come call am Richard Chibuzor Oji. When de Bobo grow, im come do dada for im head come change name join. Every body for Obodo Naija come de call am Faze.
Im talk say make we dey relate oh! Oya now, dis article wey Oga omojuwa say make I dey write go helep us to de relate wella.
For dis article, we go dey read plenty plenty gist wey go inspire us to dey relate fine with everybody wey dey near our doormot.
If una get any gist wey be say we go analyze, criticize and even deputize for here, make una send am come blossom@blcompere.com.
Make God bless all of una wey chook eye for dis page.
Na your relating Sister Blossom dey beg all of una say #AbegRelate!
Una fit follow me for twitter for @blcompere so I go show una say I pass English for WAEC.
*********************
About the author:
Born on the 26th of December, 1981 in Bauchi State and raised in Owerri, Nigeria.
She studied Science Technology at Federal Polytechnic Nekede, Owerri with bias in Biology/ Microbiology.
She had a brief work stint with Guaranty Trust Bank, Port Harcourt where she was a Customer Care officer.
She currently works with the office of the Managing Director of Pipelines and Products Marketing Company Ltd. (PPMC), a subsidiary of the Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC), Abuja, Nigeria.
She is the personality behind the brand blcompère which grew out of a passion to anchor events to a superb finish.
She is a great asset to the brand blcompère with her superb interpersonal skills and subtle tactics of branding “salience”.
Consequently, the brand grew to encompass her favorite summary of herself as shown below:
…my name is Blossom of the blcompère brand. I am a soon to be published Author, a certified Blogger and an amazing Compère and most recently, a lousy Designer… as simple as A. B. C. D…
She has been married for over 9 years to a Unique Soul mate with two adorable children.
She resides in Abuja, Nigeria with her family.
Contact me here: http://www.blcompere.com/founder
Social Links:
Twitter: www.twitter.com/blcompere
Facebook: www.facebook.com/blcompere
BBM: 2776B6E0
Website: www.blcompere.com